Politics
Wahala Dey O : Tinubu Dey Smile As Wike Don Hold Atiku And PDP For Work
Wahala Dey O : Tinubu Dey Smile As Wike Don Hold Atiku And PDP For Work

Yesterday no b small tin as Wike don open him mouth throw another bomb directly to Atiku and PDP, him talk say Secondus wey dey dance say dem pass vote of confidence on Iyorchia Ayu dey deceive himself, e say maybe him don forget say na so him dance when dem pass vote of confidence on am and yet he still resign as PDP Chairman.
Wike head no correct oh, him say make Secondus and Atiku come campaign for Rivers State make e see how dem wan do am, IF DEM NO GO COLLECT, now people don dey talk say make dem go reason with Wike oh because Rivers State na get the fourth highest registered voters and no b wetin dem suppose take gamble.
Rivers State Gov tell dem say himself and hin crew no dey fight small… small, say their fight na fight to finish and this battle no be only Wike dey am oh, I hear say Seyi Makinde of Oyo and Ikpeazu of Abia with Ortom wey dey govern Benue State support am well well too.
And if care is not taken wetin dem do Jonathan during 2015 presidential elections wey d PDP governors led by Rotimi Amaechi and co dump am na wetin wan play so to take rubbish Atiku.
For this whole matta… na Tinubu go just dey smile, him go just dey look PDP with goat eye now knowing fully well say Nyesom Wike go las las align with am to take bury the PDP finally.
This film go tough oh, make we just fold our legs begin looku looku. Meahwhile see the cover image for this TORI, Wike and Tinubu picture be like wetin d two of them plan snap o , WAHALA DEY.
Credit Bush Radio
