Why Edo Elections Go Be One-Horse Race With Monday Okpebholo Leading The Pack

Published

Why Edo Elections Go Be One-Horse Race With Monday Okpebholo Leading The PackDem dey talk say Edo elections na clash of titans, but abeg, make we yarn true talk – na who sabi do the work wey go bring the change we dey find for the state na we need as governor, no be who get big mouth dey talk like stage comedian.

Some people dey shout say na three-horse race, but make we no deceive ourselves, na only one horse dey gallop like Usain Bolt – na APC gubernatorial candidate, Senator Monday Okpebholo. This guy cool like Sunday morning, e dey calm like ice block for freezer, and na this calmness don make people dey rush am like jollof rice for party.

E don dey waka inside politics since e b small pikin, dey follow grassroots well well. The masses sabi am well well, and him don contribute plenty to him constituency and Edo state at large. Una don hear of ‘small body big engine’ before? Okpebholo aka Akpakomiza na the KOKO, the guy get levels.

Okpebholo na correct leader wey sabi leadership like pounded yam sabi Egusi soup. Him generosity no get part two, e dey make am shine like morning star pass all the other candidates. We must not miss this opportunity to get our own Home Boy for Osadebe Avenue oh.

Na real local homeboy wey sabi the hustle and dreams of the people. For the three senatorial districts, Okpebholo go win hands down because him get all the correct qualities wey we dey find.

If you dey look for leader wey go follow you chop kpof-kpof, wey go gist with you for roadside joint, na Monday Okpebholo be the man. This guy go carry Edo enter next level like Naija Idol finalist. Abeg, make we hail am, “Oga Monday, ride on! Na you we want, no shaking!

Osigwe Omo-Ikirodah

Director APC New Media Campaign Committee.

 

Author:
BushRadio

Comments

0 comments

    Join the discussion

    Use a display name or leave it blank to comment as Anonymous. Email is not required.