Connect with us

Politics

Akpakomiza For Governor! Di Real Homeboy Wey Go Bring Better Life Come Edo State!

Published

on

Akpakomiza For Governor! Di Real Homeboy Wey Go Bring Better Life Come Edo State!Edo people, make we shine our eyes and support Senator Monday Okpebholo, aka Akpakomiza, di real homeboy wey go bring di change wey we dey look for. As di governorship election dey come for September, na Akpakomiza be di man wey get di qualities and vision to move Edo State forward.....KINDLY READ THE FULL STORY HERE▶

Senator Monday Okpebholo no be ordinary politician. E be true son of di soil, a man of di people. Here be why Akpakomiza na di best choice for governor:

Akpakomiza na humble man. E no dey carry shoulder, and e dey always listen to di people. E dey approachable, and e dey respect everybody, no matter who you be. Dis man get sense! E sabi book, and e get di kind wisdom wey dey needed to solve di complex problems wey dey face Edo State. Akpakomiza sabi how things dey run for street. E no dey lose touch with di realities wey di common man dey face. E dey sharp, and e dey always find better solutions.

Di real homeboy, Akpakomiza, get strong connection with di grassroots. E sabi people well, and e dey always work with dem to bring development come di communities. Akpakomiza don show time and time again say e get big heart. E dey give back to e community, and e don touch plenty lives with e philanthropic work. Dis no be man of talk talk. Akpakomiza dey act! From building roads to improving schools and hospitals, e dey deliver on e promises. E no dey waste time, e dey move things forward.

Akpakomiza for Governor! Di real homeboy wey go bring better life come Edo State!

Osigwe Omo-Ikirodah

Director New Media

APC Campaign Council.

Advertisement
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *