Politics
2023: ANIM Don Shutdown Abuja For Tinubu/Shettima, Ready To Secure Millions Of Vote 4 APC
2023: ANIM Don Shutdown Abuja For Tinubu/Shettima, Ready To Secure Millions Of Vote 4 APC....KINDLY READ THE FULL STORY HERE▶
Yesterday no be small doings as the National leadership of the APC National Integrity Movement (ANIM) takeover Abuja like play-like play when dem gada togeda to confirm their support for APC presidential candidate, Asiwaju Bola Tinubu and hin running mate, Senator Kashim Shettima.
The group visit to the campaign office of Tinubu/Shettima carry weight no b small, cheerful faces and beautiful people full ground as them come break am down the strategies wey dem go use to take secure millions of votes from Nigerians to support the APC for the presidential election.
According to their oga wey follow dem come, Alhaji Sadiq Sa’adu 2023 na sure bet for Tinubu and Shettima.
For hin own part the APC vice presidential candidate, Kashim Shettima wey happy well well when him see the powerful delegation beg dem make dem join hands with himself and Asiwaju for the new transformation wey dem wan bring come for Nigerians.
The meeting GO WELL , see beta pictures below from the event wey don break the internet since yesterday.
Source: BushRadio


