Politics
“Last Last E Go Reach Everybody” – Big Yawa As Edo State Governor, Obaseki Convoy Enter One Chance For Flood (Video Wey Go Make You Laugh)
“Last Last E Go Reach Everybody” – Big Yawa As Edo State Governor, Obaseki Convoy Enter One Chance For Flood (Video Wey Go Make You Laugh)....KINDLY READ THE FULL STORY HERE▶
Written By Oshiobugie Omo-Ikirodah
Na serious gobe happen as Godwin Obaseki, the Executive Governor of Edo State, convoy enter one chance inside flood. This na after him dey do wayo wayo thing come dey give Edo people suffer head. The kind bad governance wey Obaseki carry come Edo State, e don finally backfire for am. CONTINUE READING
Obaseki convoy come jam kasala as flood hold dem for road wey dey go Auchi. Na this same road don cause yawa scatter for internet. You go even think say na soja man dey try wade through enemy line during war. The video of the gbege, wey people don share taya, dey make person laugh like say tomorrow no dey.
As the mata take be, some people don dey claim say na federal road. Others come dey yab, talk say “if e dey pepper am e no go repair am?. Dem talk say na Auchi road be the first wahala, say if person just enter Benin city, e go begin cry because of the bad road. CONTINUE READING
The thing be say, if person dey use hand dey find wahala, one day wahala go waka come meet am. As Obaseki take dey treat Edo people so, na so him take see him own. Na the thing wey old people dey talk be say ‘monkey go go market e no go return.’ E be like say Obaseki own na ‘governor go use convoy waka e no go fit pass.’
Last last, as dem dey do Edo people, na so e go reach everybody.
Watch the video below na better laugh you wan burst so;
https://twitter.com/JOBIdient/status/1682837285954355201?s=20
Source: Bushradiogist
