Politics
Casala Don Burst: Obaseki SSAs Don Resign, Jump Ship as Gov No Fit Pay Salaries – Asue Go Worse!
Casala Don Burst: Obaseki SSAs Don Resign, Jump Ship as Gov No Fit Pay Salaries – Asue Go Worse!Wetin be this? As the Edo election dey near, wahala don gas for PDP as four of Governor Obaseki’s Senior Special Assistants (SSAs) don use leg waka, dump the governor like bad habit. The reason? Gov Obaseki no fit pay dem salaries! If Obaseki no fit settle these ones, who wan believe say Asue go even try?
The four SSAs wey don vex comot na Osayande Emenya, Timothy Edokpolo, Ukato Osaheni Henry, and Efosa Edo-Osagie Jr. Dem don tire for Obaseki style of government wey dey do like “salary na myth.” Osayande, wey be PDP Oredo Ward 06 Organizing Secretary, talk say him don suffer enough. Baba shout say dem no gree pay am shishi since e start work. Him talk say loyalty no dey pay for PDP – or rather, Obaseki no gree pay.
Edokpolo from Ikpoba-Okha yarn say PDP no be the problem, na Obaseki be the wahala. How person go dey work, but the salary no go drop? He talk say, “I no sign up for charity work o!” Na internal crisis and hunger dey push these people comot, and dem no fit wait make dem turn skeleton before salary show.
Ukato and Efosa sef no waste time. Dem join the resign waka, saying dem no fit carry empty pocket follow Obaseki enter next election.
Now, the question wey Edo people need to ask be: if Obaseki no fit pay ordinary SSAs, wetin go happen if Asue enter? Asue go even sabi where money dey? Abi na promise and fail part 2? PDP gatz wake up before all their loyalists carry their waka enter APC.
As election dey come, Edo people need to shine eye like torchlight o, because if Obaseki don turn salary to myth, na Asue go finish the chapter!
Osigwe Omo-Ikirodah his the Chairman and CEO of Bush Radio Academy.
